femi kuti – sorry sorry lyrics
if my eyes no decieve me
and na true be things my ears dey hear
politicians and soldiers make e meeting
our country dem wan repair
dem dey make like say
dem know o know
say na dem a spoil our country so
as dem dey dabaru am dey o
na so my people dey follow o o
i sorry sorry o, i sorry for nigeria,
i sorry sorry o, i sorry for africa
sorry sorry o
i sorry sorry o, i sorry for nigeria,
i sorry sorry o, i sorry for africa
sorry sorry o
as we [never get decided]…
look my friends
dem no like to hear word
na to dey follow follow, follow dem enemies
like zombie, dem dey go dey march dey go
dey fight for other people
wey spoil nigeria so
these politicians and soldiers
dem be one and the same
no one different [from] the other
my people no wan know
but with kind of leaders
africa no get hope
africans will suffer
we go suffer reach our bone
i sorry sorry o, i sorry for nigeria,
i sorry sorry o, e gba mi o
sorry sorry o
i sorry sorry o, i sorry for nigeria,
i sorry sorry o, i sorry for africa
i sorry sorry o, e gba mi o
Random Lyrics
- francis rossi – tallulahs waiting lyrics
- frankie laine – i married an angel lyrics
- freak kitchen – sob story lyrics
- four tops – loving you is sweeter than ever lyrics
- four freshmen – day by day lyrics
- freddie mercury – somebody to love lyrics
- fear nuttin band – real music lyrics
- fred astaire – how are things in glocca morra lyrics
- floyd tillman – i love you so much it hurts lyrics
- foxxi misq – ultimate girls lyrics