azlyrics.biz
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

egwu nnanna echem - f-sharp lyrics

Loading...

f+sharp
i go lie for you!?
old man no dey ever talk say him be orphan
if you come from poor background
better hold the torch and lantern

this talk about failure, na failed attempt at motivation
like akamu wey no make am
second chance, na just frustration

standing ovation for who fail and start afresh
na lack of experience for uni na him dey make starter fresh

no forget wetin ted talk, failure no be prank
wetin you go do when you fall inside sharktank?
when money no dey your bank?
ask oga frank, “phone a friend” na option to call person wey dey your rank
dem fit try to give the answers
but na you siddon for hot seat
you like food, but you forget sey kitchen get heat
dem tell you say “wetin no k!ll you makes you stronger”
if i see you for icu, my advice go make you stronger?

i go lie for you!?
na why wisdom hard to come by
who don watch final destination, no go just dey stand by
you go go the extra mile…
cos if to make am na the default
your failure go be your fault
when you default to put the effort
so step forth, make you no go ‘plead the fifth.’
explain taya… no evidence for who no make am
opportunity yapa, you just dey slack, you no wan take am
so as you dey grow, no fake am
life na exam, do your best
but if you no know the course, no ‘pass am.’
so sister, get the info. get the info
broda look yourself for mirror
life no get control zed
you fit be seeker, make zedicus be hero
if you fail and start again, at least you no go start from zero
when life give you full stop, add 2 more, you get the biro
i go lie for you?!



Random Lyrics

HOT LYRICS

Loading...