fela kuti - power show lyrics
i open my eye i see for my land
-(chorus) na wrong show o
everywhere you go
everywhere you dey
everybody want do power show
na wrong show o
you reach boarder immigration
officer dey
him go bluff you
waste your time
change him pants
some dey comb dem hair
den tidy dem table
den dem pull dem chair
before him go know say you dey there
if you no talk quick
him go go for sh-t
him go sh-t come-back
and you talk to am
then you suprise when him
shack for you
him go say you no go cross
you no go cross today
na that time dem go start dem
power show o o
na wrong show
go post office na the same
dem go bluff you
waste your time
run you up
and then run you down
dem go tire your body
and then tire your mind
and them tire your whole mind
dem go say no change for fifty kobo
na that time dem go start them
power show o o
na wrong show o
motor car owner sef him go take
him car push him car push laborer
down for road
then him start to yab
foolish labourer
nonent-ty, him no get money
look him sandals e don tear finish
look him trouser e don tear for yansh
look him singlet e don dirty finish
look him body e no bath this morning
look him pocket e don dry finish
you go suffer for nothing
you go suffer for nothing
you no know me sha?
i be general for army office i
i be officer for police station
i be secretary for government office
you foolish laborer, nonent-ty,
you go suffer for nothing
na that time dem go start dem
power show
na wrong show o
power show
na sad thing
na bad thing
na wrong show o
power na to help your land
na to help your mates
na wrong show o
Random Lyrics
- alice peacock - all consuming love lyrics
- pentangle - omie wise lyrics
- bing crosby - little one lyrics
- hard milk - trendsetter lyrics
- hard milk - kisah lalu lyrics
- fela kuti - expensive shit lyrics
- 5dolls - like this or like that lyrics
- mike posner - the way it used to be lyrics
- eartha - i'm still standing lyrics
- pentangle - the toss of golden hair lyrics