azlyrics.biz
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

holiyo – it is well forever lyrics

Loading...

it is e well with me o;
it shall be well with you o
and it must be well with us o
forever

people wey no fear god o
them think say life go bad o
my life just dey better o
forever

baba god say na so o
i don dey see better o
na so god want for me o
forever

them don go swear for me o
na so their power fail o
i don dey hamma for here o
forever

them don throw jazz for me o
them say i do juju o
but na jesus stand for me o
forеver

i say, it is e well with mе o;
it shall be well with you o
and it must be well with us o
forever
uncle, aunty
make you no worry
wetin dey sh+lle
baba dey see am
when e go happen
your eyes go clear
and you go fear god

ewo, it is e well with me o;
it shall be well with you o
and it must be well with us o
forever

wahala dey for them o
them no go see our back o
them no go fit oppress o
forever

e don dey reach your time o
better must come to you o
baba don sign for you o
forever

them think say me i go die o
na so them wait and die o
baba god save my life o
forever
them tie dumb baby for bush o
them think say na me them tie o
na so their cup come full o
forever

i say, it is e well with me o;
it shall be well with you o
and it must be well with us o
forever

mama, papa
god dey see you
brother, sister
god he too much
enemies go scatter
your god too strong
people go see am
say god do better
for me and you
them call our name
baba god show
na so them fall
our god don do am

ewo, it is e well with me o;
it shall be well with you o
and it must be well with us o
forever
it is e well with me o;
it shall be well with you o
and it must be well with us o
forever



Random Lyrics

HOT LYRICS

Loading...