kharis official - god dey lyrics
[intro]
ay! oluwa kharis
i say god e dey 4 for you.. god e dey for you..
deeeey for you..
[chorus]
god e dey for you (he dey for you, he dey for you)
god e dey for you (dey for, him dey for you)
e no matter the hustle
e no matter the struggle
him go see you through
[verse 1]
ten months gone now, eye don dey red oh
all the new year resolution just be like scam oh
time do dey go even bar i never get yet
car and the house wey i plan still dey express
container empty, goods never near land
water don dey p-ss garri, sg(sabon gari) no be main land
mama don dey call for house, say na when the bar go show?
all your siblings don dey ask, say na when you sef go blow?
last year you been promise mary say u go wed her for june
now december don dey reach, intro sef you never do
account steady on a low, naira bet they support you
now your faith come dey die, see your mind e don divide
shey dis god no send my matter abi him no put me eye
pay offering i pay my t-the
go to church i pray for night
still yet i no dey alright
everything no dey alright
dey say make i calm but i’m tempted i wan ask am why…
[chorus]
god e dey for you (he dey for you, he dey for you)
god e dey for you (dey for, him dey for you)
e no matter the hustle
e no matter the struggle
him go see you through
[verse 2]
most times me sef i no go lie oh
doubt dey disturb me, mood swings dey worry me
always i dey feel dead, my feelings burry me
many things i no fit talk, sometimes i dey try explain
only god na him know whasup
pressure just dey buckle up
try so hard to stay together, body no be bubble gum
daily bread dey come like dinner breakfast don become late
dead inside situations, see e don comot faith
smile don become pain
sometimes i dey feel inferior cause me wan become straight
but now i no go fear the breaking, cuz him be potter me i know say him go make me, him go fix me
well i no go loose hope, steady i go trust him
steady i go trust the process cause i know he got me
i no go loose hope steady i go trust him, steady i go trust the process cuz i know he got me
[chorus]
god e dey for you (he dey for you, he dey for you)
god e dey for you (dey for, him dey for you)
e no matter the hustle
e no matter the struggle
him go see you through
[bridge]
e no matter the brokeness
e no matter the weakness
e no matter the sickness
e no matter the problem
e no matter the hustle, matter the yawa oh yeah
him dey for you, him dey for you, him dey for you..
e no matter the sickness
e no matter the problem
e no matter the yawa
e no matter the yawa oh, matter the problem oh, him get the solution oh, him dey for you, him dey for you, him dey for you….
Random Lyrics
- wale - face down lyrics
- killah priest - the funeral lyrics
- j-dawg - cold blooded lyrics
- dvn4enkx & atris - тян без костей (the girl without bones) lyrics
- sxoza - fila lyrics
- bright eyes - we're going to be friends (the white stripes cover) lyrics
- booty&thekidd - cold blue lyrics
- are (finland) - teknologiafobia lyrics
- cosmos (vocal group) - mmm mmm mmm mmm lyrics
- liquit walker - überchefs lyrics