marvie kings - this story never end lyrics
verse 01:
e don tey wey i dey suffer;
no pesin chuk mouth for my matter
wetin i dey see
big pass wetin i gree;
but na your hand i dey oooo;
na your hand i dey oooo
verse 02:
many times i feel like asking: “shey na me be the worse?
why my life dey like say na cross?”
me i know say i don try, but why i dey down?
when my time go finally come?
refrain:
(but) this story never end oooo +
me, i never dance;
na you i dey wait on;
baba, me i dey wait oooo
this story never end oooo +
me, i never sing;
e get wetin you tell me;
baba, me i dey wait oooo
verse 03:
they don talk am, say i no go dance;
say in this life, i don lose my chance;
but me, i no kwe;
i say, i no kwe;
na your hand i dey oooo;
and my time no go tey oooo
refrain:
(cos) this story never end oooo +
me, i never dance;
na you i dey wait on;
baba, me i dey wait oooo
this story never end oooo +
me, i never sing;
e get wetin you tell me;
baba, me i dey wait oooo
bridge:
dem say i go tire
cos say i no go make am
but baba, na your voice i hear
moments right before now
they make me fall down;
but baba, na your hand i see
Random Lyrics
- iwan fals - lagu tiga lyrics
- alex sid - aeriko lyrics
- hawkpro - oikawa rap | beast | lyrics
- kwesi nurse - melanin wine lyrics
- tim low - reikiavik lyrics
- until it rains - melodies lyrics
- 021kid - comfy lyrics
- oct! - don't touch my clogs lyrics
- ethan buckner - treading water lyrics
- moskva surfing club - 삼라만상 (samramansang) lyrics