mg pablo - abudulahi lyrics
verse 1
abdullahi tell me why + why you had to go…
i still remember promises you made to mama years ago
abdullahi na my guy + n+gga wey dey calm…
he be cooler than an ice mehn + this n+gga no get qualms…
abudulahi no get time + but he dey like some watches…
financially he fit red but steady e dy eye those porsches…
when he dy the dark na allah dey shine he torches…
started on the right foot + nah hе never needed clutchеs…
abdullahi na from the street + you suppose know how e dey be…
mumsy dey work for gov + most times dem find am hard to eat…
abdulahi the only son + and he get like 3 sis…
he don drop out from school + since through primary 6
abdulahi too dey smart and he loyal as he be…
so one egbon for area don dey chuck am with the pin…
don dey send am all the kpo + don dey send am all the trees…
i no believe my eyes first time i see am smoking trees…
abdulahi still too young + all of us dey like 14…
but he no dy sleep for house + dem no dey see am for like weeks..
the last time i see am he say he go try to change…
but e no dey let am do cause egbon dey give am change…
i know say you gats survive + even me i no fit feed you…
but no put your hand + for anything wey go k!ll you..
he tell me say gvdafi calm down+ you too dey bother…
if i dull like you dey tell me + who go come dey feed my mother…
shortly e never too tey abdulahi don dey push…
every kind of drugs + plus e don still enter bush..
he tell me make i follow up + he say i too dey goof…
say the goal na to stack the papers till e break the roof…
my n+gga don be druggie now he dey do ice and coke…
he said i rather rich and die young than living long and broke…
as he dey clear me how e be + i swear my eyes dey soak…
cause this n+gga be like bro to me + and i love am no be joke…
i still remember when he tell say dem k!ll one of he guy…
i saw his heart gettin cold + i see the fears up in his eyes…
he say i for don craze if no be say me i dey high…
he say like 5 n+ggas must drop for him n+ggas when dem kpie…
gang life na him family + and drugs be his escape…
every night he dy stay awake + dey think about he fate…
him mumsy don notice for long + every night na she dey pray…
but evil wey he do for night must catch up by the day…
one faithful night like that + we dey our bed dey sleep…
when we heard several gunshots + bullets dey rain for our zinc…
we think say na armed robbers + so we hurry call police…
but dem no agree to come + dem put the line for busy…
i almost die from fear that night + non of us fit sleep…
the thing affect so deep + now i get ptsd
straight i go down on my kneels + pray the lord my soul to keep…
i look my mumsy for her eyes + i observe say she dey weep…
day break everywhere calm + some people gather down the street…
for my mind na wetin sup last night dem dey reason for real…
now i say make reach there + so i go know what’s up the deal…
as i dey get close + who i see na nurudeen..
na him come chuck me the pin say my n+gga man don go…
as i step further + i see my n+gga man for cold blood…
e pain me reach my bone when i see him mumsy dey groan…
plus him 3 sis dem dey cry without control
abudulahi why you go…
abudulahi why you go like this?
Random Lyrics
- feng (uk) - who do u wanna be lyrics
- wino willy x maze overlay - transform lyrics
- ground feels like mattress - tricks 4 u lyrics
- kylie minogue - you ain't ready lyrics
- system f - cry (circadian rework) lyrics
- envi jordan - ultimate lover lyrics
- trendux - alleviate lyrics
- jane remover - my face* lyrics
- erykah badu - baddiehubshop.com lyrics
- da grimm one - successful (remastered) lyrics