azlyrics.biz
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

styl plus – iya basira lyrics

Loading...

this na one buka wey i dey like to go.
the food sweet sote e go make your mind blow, day and night iya bas how she do am i no know.
they think say na jazz, my broad no be so.

chorus:
people people make una come o
iya basira e don jazz me o, ooo
everybody helep save me o
i no dey sabi chop ati my moda or my girlfriends place
people people make una come o
iya basira e go kill me o, ooo
everybody helep save me o
i no dey sabi chop again my moda or my girlfriends food.

long throat na food go kill u-no be so, i say na food go kill u – oga mi no be so.

wettin dey be say e get one day wey i say i go play go see my paddy sunday,
na so i reach there but sunday e don high on beer luckily for me him junior broad eye e clear,
he say make we stroll to the area, little did i knw that i was strolling to my burial.
right there were oshodi bus dey load was a little buka close to the mainroad.
i laf when e p-ss the door, e tell me say hin name na iya bas for short but i bow when e order,
iwesiatewa, ero mm purewater not even mineral. i come gree say i go manage to chop am
before i realize i dey order 2nd round, 3rd round, 4th round, i never still stop
wetting iya basira e give me chop?
repeat chorus.

long throat, na food go kill u, na food go kill u.

oga mi, u think say na play when i say na the way wey i dey, e no day ok
wetting be your own advice, i don dey steal my paddy money to buy iya basira rice.
even on my girlfriend birthday when she dey wait make i take am to ocean view,
i no know when i p-ss the place, the only thing wey dey my mind na iya basira palm oil stew
ah! kilon kilon shele shele me i never see this kind juju, telle telle
all those wey go vex kpele kpele, but i hear say iya basira na…….
i sure say still i go go there go sidon, order my first round move
to 2nd round, 3rd round 4th round i no dey ever stop wetting iya basira come give me chop?
repeat chorus.

officer abeggi follow me to the palce, everybody don telli me i dey craze
my girlfriend don leave me my moda no gree see me my paddy ah! iya basira e don kill me. (x2)
oya people, people make una stop officer e don come
where the woman, hin dey inside, (oga i dey come)
woman na wetting u dey give people chop wey dey cause all this wahala casala, oya make we talk
oga sir true to god, nothing wey i dey put for the food wey i dey cook, na god dey make am good.
na which kind talk be that, say na god dey cook the food abi u think say i be fool no be juju u dey put,
infact i dey suspect say na….u wash put sote people dey queue come dey rush for your stew,
well to confirm am bring am make i chop small. give me fufu 90 naira plus that soup wey dey draw.
chaii correct this food sweet no be small shey una no go vex if i still order for more.
officer no worry na the food be this
oya people, people make una go, case dismiss.

repeat chorus 2 times.



Random Lyrics

HOT LYRICS

Loading...