azlyrics.biz
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

2shots – lagos life lyrics

Loading...

everybody won come lagos make money
dense population see crowd for oshodi
every day for lagos na wahala
if e no be riot
na petrol palava
money miss road on different occasions
one milina, several imitations
aba na the source, lagos na the market
wetin dey the inside
no be wetin dey the packet
if you no get sense dem go just gbawunlogu
every business man won gba inyetogu
plenty stress, very little progress
all the hustlе and bustle has a negative еffect
na dirty dirty full the city
what of the ladies dem be ashi
plenty dey broke
very little dey flashy
when they match with lagos
ehn, you better fashi
lagos life na stress oh (8x)
to get money na crime
you dey guilty as charged
boys dey try hustle money
dem duty at large
na so the money scarce
men eyawh
na only god fit save man from this wahala
monday morning for lagos en never change
you fit flenge for weekend
but no just try am again
a form of mass movement moluwe
if you no sabi hang
danfo dey there
officer for check point na like 20 bucks
traffic na die my guy bon hold up
egoye no dey
men the heat punish
thank god for pur water so we go try manage
watch conductor too dey cry
all na shakara
miologe
agbero boys still go dey tag
if you won form levels
you go try follow cab
otherwise na okada or saps
lagos life na stress oh (8x)
no city get gbedu up to this level
no try oh we dey g+yve oh
happening city omo we dey gon
na always busy, we dey play gon
everybody just dey wait for the weekend
ogbe na friday
i fit go on free +++
waka to the club, scoping for chicken
yan up small till the party begin
you go get up
you go start sipping
what a jam, of course na my record
when my city spot, on top, on top
how we dey rock
nonstop, non stop
our guys nkor baffed up, baffed up
our girls nkor, shey you no trust
l a g o s, best in the west
blessed to impress
don’t test with the rest
lagos life na stress oh (8x)
(instrumentals)
lagos life na stress oh (4x)



Random Lyrics

HOT LYRICS

Loading...