azlyrics.biz
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

brymo – illusion lyrics

Loading...

you carry boyi go yonder
you say he no go go oh
slavers boku round town him brother tell am oh
stand for your ground
make you no hurry follow go
them dey sell people troway
my brother no go oh

the people them wey go river them never return oh
them say na mami water carry everybody go oh
for full moon, papa go farm he never return oh
them say na the forest carry am swallow oh
listen boyi
life no balance at all oh
you go place you no know
you no go return oh

boyi feeling true
him heart dey beat for the road oh
him fate na to follow them
follow journey go

ah ah ah ah ah
wetin i think i become ah
ah ah ah ah ah
na illusion them dey sell you so

boyi look forth, him look out, no other place to go oh
he carry him few belongings, reluctantly follow go

for this life we dey, the things you do you know oh
e better to go reach the place find how e dey oh

i talk am, i shout am, boyi still dey travel go
na destiny dey push man where him dey go ah
he try am, he fight am, urge strong no be small
the tori e dey the place where him dey go ah

ah ah ah ah ah ah
na wetin i think i become
ah ah ah ah ah
na illusion dem dey promise you so ah

hmmn hmmmn hmmn
oga master no wan know value pig fat pass people oh
he say dem be property with him dog dem equal oh

boyi clean gun, he shave beard
oga trust no other
he for adopt boyi, but him people go hala

that night boyi take razor he shave am proper the way oga dey like am
no touch him moustache ah

poison for soup
for family and the guys them
he slash master throat too from ear to ear ah

ah ah ah ah ah
boyi na most wanted for strange country ah
ah ah ah ah ah
he dey gather soldiers ah
from plantations he dey break boys free ah
(clears throat)
ehn ehn
my people
the main reason we gather here today, na him concern us now
na there we dey go next
ah today on behalf of the people of the city and the township, the entire tribe and our very very race, we go unveil this statue of boyi
we go give our honorable personality himself the scissors to use cut the ribbon
for service to humanity and to race and eh we salute you sir
we salute you well well, because you really touch our lives, you don change our lives from generation to generation to come
nothing go ever remain the same for us
yes, this statue na the honor of your greatness
thank you



Random Lyrics

HOT LYRICS

Loading...